Abubakar Kyari
Hau e go bi
Abubakar Kari CON (dem bon am omy 15 January 1963) na Naija politshan wey bi Minista of Agriculture and Food Security. Bifor dat one, na e bi senator wey represent Borno North Senatorial District fom 2015 til e risaign for April 2022. E de for All Progressives Congress (APC) parti, and smol taim for 2023, e sarf as aktin nashonal chairman of di parti.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Two ways dey to tek handu di wahala of youth wey no get wok or wey jos dey idle. One na to mek edukeshon cheap and eazi for dem to rish, di sekond one na to sopot dem to mek dem fit stat smol biznes wey go hep dem stan wel.
- INTERVIEW: Boko Haram: One can travel 300km without seeing human activity in Borno North – Senator. 28 November 2020, Premium Times Newspaper.
- We get meni yung pipul wey don pas di levu wia you fit dey beg dem to go bak school. Instead, mek you hep dem smol, giv dem sopot wey go mek dem fit stat smol biznes, so dem fit tek kia of dia famili.
- INTERVIEW: Boko Haram: One can travel 300km without seeing human activity in Borno North – Senator. 28 November 2020, Premium Times Newspaper.