Jump to content

Adunni Ade

From Wikitok
Adunni Ade (2020)

Adunni Adewale (wey dem bon for 7 June 1976) na wuman wey dey akt film and dey du model wok, shi get Naija and America blod. Dem bon am for Queens for New York, im mama na America wuman wey get Germany famili, and im papa na man from Lagos for Naija.

  • Islam wey dem tich mi tok say na God (Allah) dey luk di plan wey dey awa heart bifor im joj os. Na wetin dey inside pesin mata, no bi wetin bodi show outside. I no dey find mek pipul like memi by fos. I wan mek pipul liv dia life wel and mek dem fit du beta beta tins for dia life.
  • I no get frends, I no even nid frends, na muzik bi my frend. Muzik don help my heart for long time. I like meni type of muzik and I dey respet plenti muzishans for hia and for oda kontri. Yu no go eva si mi hate eni pesin.
  • Plenti singul mama or papa dey try wel to tek kia of diasef and dia children pas som pipul wey dey stay for bad and painful rileshonship. Rileshonship no sopoz tok wu yu bi. Ya strong wok, ya efot, and hau yu no dey giv up for life sopoz bi ya fokos. Jos bikos plenti of us no dey tok awa life tori outside no min say wi neva sofa and survive. Face ya life! Face ya wok! Bi gud ezampul for odas! Mek pipul rimemba yu for gud pas bad.