Ahmed Musa
Hau e go bi

Ahmed Musa (wey dem bon for 14 October 1992) na Naija futbola wey dey play as forward and left winga for Turkish Süper Lig club Sivasspor and Nigeria national team.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Di only tin I go tok be say mek we kontiniu to dey disiplin. We sabi say futbolas like enjoiment, but wen e rich wok, you gats respet am. Wen e rich time to enjoi, you fit enjoi, but wen e rich time for wok, you gats focus. If you mix di two anyhow, you no go fit giv your bodi beta rest afta mach, and e go afekt how you go tek pafom.
- My dream is to become Nigeria’s most capped footballer –Musa. Punch, 30 May 2021
- Evribodi wan get chance to play for Nigeria, so enibodi wey dem give chance go show wetin e sabi do. Na why I biliv say everibodi redi to play wen mach kom.
- Ahmed Musa Interview: Every Word On Preparations, Eagles Injury Problems, Chukwueze, South Africa Team. allnigeriasoccer.com, 15 November 2018.
- We sabi our kontri. No mata wetin, once dem kol your name, pipul go always tok. But me, I no nid listen to enibodi. Na me dey do my wok. If my bod tel me say mek I stop, I go stop. Right now, I stil dey play for my club, and I get beta contract, so why e go concern enibodi if I wan stil play for national team?
- I’ll quit Eagles when my body says so —Ahmed Musa. The Guardian (Nigeria), 14 September 2012.