Alex Iwobi
Hau e go bi

Alexander Chuka Iwobi (wey dem bon for 3 May 1996) na Naija futbola wey dey play as rait midfida abi rait winga for Everton wey dey for Premier League, and for Naija nashona tim.
Tins wey e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Nau wey I don grow, I sabi handul bad bele wel-wel. Bifor bifor, wen I stil smol, I no sabi wetin to du wen pipul dey tok bad abi I dey fil bad. I jos stop to play bol for smol taim, I wan jos dey alone mek I tink my own tins. I no laik to dey tok or mek pesin dey tel mi wetin to du.
- “I probably shouldn’t say this” – Alex Iwobi reveals the Everton manager who told him to leave. Soccernet.ng, 7 November 2022.
- For futbol, e no dey always swit. Somtaims e dey had. Bifor I ivun rich Everton, I don si plenti wahala, bot I always dey trai waka pas am.
- IWOBI: I ALWAYS BELIEVED I'D SUCCEED AT EVERTON. Everton FC, 27 September 2022
- One taim, I no dey play wel and Afcon no swit for me at ol. Bot I yuz dat bad taim tek jinja maisef, mek I kom bak strong and dey redi again.
- Alex Iwobi interview: Everton midfielder on a mission after seasons of turmoil. The National News, 4 August 2022.