Jump to content

Aliko Dangote

From Wikitok
Aliko Dangote

Aliko Dangote (wey dem bon for 10 April 1957 for Kano, Naija) na Muslim man wey sabi buznes wel wel. Na im get Dangote Group. E dey do big-big factory wok. Di pipul wey dey count rich pipul for di wold (Forbes) tok say Dangote na di Richest Man for Africa, and for 2013, e be di Richest Black Man for di whole word. Dem ivun tok say for one time, e be nomba 23 for di list of richest pipul for Earth.

  • No mata wetin you dey du, trai mek yu bi di best pesin wey sabi du am pas odas.
    • Forbes 20 Inspirational Quotes from the Richest Africans.
  • No bi biznes pipul from anoda kontri biud South Korea — na di pipul wey dey liv dia biud am by diasef. Germans tu na dem biud dia own kontri bak, ivun wen di ples don skata bifor. Dem sofa plenti, bot today dem dey among di best for wold.

Wetin pipul tok abaut Dangote

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Dangote go trai du evri evri wey e fit du—stil folo di law—mek shwo say e win. Di pipul wey no win go olways dey komplen.
  • E get swit maut and e dey hombul...
    • Theresa Okeke, American director of Lagos' Civic Centre, a recreational centre for the well to do.
  • One taim wey Dangote go Tanzania, e tok say e drim na to get African biznes wey go dey mek tins for difrent-difrent kontri for Africa.