Babajide Sanwo-Olu
Hau e go bi

Babajide Olusola Sanwo-Olu (wey dem bon 25 June 1965) na Naija politishan wey don dey serve as govnor of Lagos State sins 2019. E bikom govnor onda All Progressives Congress (APC) afta e kontest and win di APC pramari elekshon for October 2018, ivun do pipul no espet say e go win against di govnor wey dey dat taim, Akinwunmi Ambode.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Wi wan mek awa pipul stil rimen Naija pipul, bot stil get chans to enjoi beta tins from ol ova di world.
- The Babajide Sanwo-Olu Interview: We’re Competing With Ourselves But We Can’t Just Be Okay With The Status Quo. The Gazelle News. November 19, 2023
- To govan Lagos no bi play or geswok. As yu enta, yu gatz bigin wok shap shap.
- I am confident of re-election, says Sanwo-Olu. Punch NG. 8 August 2022
- If wahala hapun for 3 o’clock for nait, wu yu go kol? Yu go kol pesin wey get espiriens, wey don pas tru had taim bifor, wey sabi wetin dey hapun and fit ondastand yor problem ivun for dat kain taim? Or yu go liv yor mata for pesin wey no ivun sabi wie swich dey, or wetin govanans min?
- I am confident of re-election, says Sanwo-Olu. Punch NG. 8 August 2022
- Mek wi kontiniu to put moni for ples wey go mek pipul laif beta. Mek wi kontiniu to help di pworest pipul for awa land.
- Sanwo-Olu urges states to invest in people-oriented projects. Punch NG. 23 December 2023
- Mek wi yuz teknoloji tek help os no wie problem dey, so wi no go kari help giv rong pipul or du mistek wey go kos mor wahala.
- Sanwo-Olu urges states to invest in people-oriented projects. Punch NG. 23 December 2023