Burna Boy
Hau e go bi

Damini Ebunoluwa Ogulu MFR (wey dem bon for 2 July 1991) wey pipul sabi wel wel as Burna boy na Naija singa, song raita an rekod produsa. Pipul sabi to no Burna Boy as e rilis di muzik "Like to Party" . Like to Party na di lid singu from e fest studio habom L.I.F.E (2013).
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- A wise pesin fit du like mumu, but a mumu pesin no go fit du like a wise pesin.
- "Burna Boy quote on Twitter ", 21 October 2023
- No evidens, yu go esplen taya.
- "Burna Boy's catchphrase appears in exams", Itunu Azeez Kareem 22 August 2023.
- If yu no mek am, na so yu go dey esplen evri-tin wey yu dey du. Di nid to esplen taya dey kom bikos pesin no mek am for wetin e dey du.
- "Burna Boy's catchphrase appears in exams", Itunu Azeez Kareem 22 August 2023.
- If yu no spik yor trut, di lai go kom bikom yor trut.
- "Burna Boy's quotes", Uganda Empya
- I no dey for ol dos podkast/ring light levul abeg. I bi profeshonal for mai wok; na onli profeshonal for im wok dey kwolifai to du intaviu wit ODG
- At di end of di day, evri-tin wey pesin dey poshu to get go fainali ron liv pesin.
- "Burna Boy's quotes", Uganda Empya