Jump to content

Callistus Valentine Onaga

From Wikitok

Callistus Valentine Onaga (wey dem bon for 29 September 1958) na Naija big pastor for Roman Catholic Church wey dey sav as bishop for Enugu side.

  • I hapi wel wel say I fit tek dis vaccine today. I wan beg evribodi wey lov im life and bi pikin of God mek dem du di sem. Mek una foget ol di fake tok wey pipul dey spred. Wi don tek vaccine bifor for yellow fever and odas, and I beg mek pipul go tek dis one tu, so dat wi fit stop hau dis siknes dey spred. Wi dey beg evribodi, evri Katolik and evri Kristen, mek una go tek dis vaccine. E go help us sav God beta and laif go kom bak to nomal.