Carlos Amigo Vallejo
Hau e go bi
Carlos Amigo Vallejo (wey dem bon for 23 August 1934, and e kpai for 27 April 2022) na holi man from Spain wey dey for Katolik Choch, and e serve as archbishop for Tanger eria and also for Seville eria.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- E no bi say wi go dey du niu-niu tins, but e min say wi gatz remain tru and faithful to wetin Christian life rili bi. Som pipul dey tink say renewal min say niu tins go kom or somtin like dat. But di tru renewal go help us klin awasef smol, so dat di face of Jesus Christ go shine for awa own face, bikos na dis one bi di ril minin of Christian life.