Chidi Amuta
Hau e go bi
Dr. Chidi Amuta (wey dem bon for 21 July 1953) na buk pesin, pesin wey sabi rait, dey tok for newspaper, rait long tok, and advais govment pipul.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- For os to liv in pis wit oda pipul for dis awa kontri wey get meni difrent kaind pipul, wi gatz yuz wetin wi sabi and stil respet oda pipul own filin tu.
- Don’t Sit at Home, Go out and Face Nigeria. Thisday Newspaper Backpage Editorial. September 9, 2021.
- Na so Naija politishan dey du laik say politiks na war. Dem dey fait laik say na batul, and dem go yuz enitin wey dem get to win dia oponet.
- Don’t Sit at Home, Go out and Face Nigeria. Thisday Newspaper Backpage Editorial. September 9, 2021.
- For ol di big pipul wey don rul Naija, President Buhari get him own spechial sit wey nobodi fit drag. Na onli am Kom bak as lida not bikos of wetin e du bifor, bot bikos of one kain tori wey pipul jos dey biliv. Pipul wey dey push Buhari mata bifor 2015 elekshon no get beta pruf, na jos old tori dem dey yuz sel am.
- Don’t Sit at Home, Go out and Face Nigeria. Thisday Newspaper Backpage Editorial. September 9, 2021.