Chris Oyakhilome
Hau e go bi

Christian Oyakhilome (wey dem bon for 7 December 1963), wey pipul sabi as Pastor Chris, na Kristien lida, pastor, buk raita, pesin wey dey help pipul, dey prich for TV, and na oga for Loveworld Incorporated. Na him stat di big choch wey dem dey kol Christ Embassy and na him rait di evriday buk wey pipul dey read – Rhapsody of Realities.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- If yu neva win wit God for prayer, yu no fit win wi pipul. Yor viktri gatz hapun for spirit bifor e go show for ril laif.
- Somtaims, ivun if you pray, di wahala no go go. If e no go, e min say God biliv say yu don strong enuf to fes am and win.
- King no dey beg, na komand dem dey giv. King get onli one wok – to rul. God don mek yu king. Rul wel, no beg enibodi!