Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu
Hau e go bi
Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu (wey dem bon for 4 November 1933, and e kpai for 26 November 2011) na Naija soja and politishan wey lid di kontri wey brek komot wey dem kol Biafra for smol time.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Una don send mi to anauns say, from today, Eastern Nigeria go ton to one independent kontri. So mi, Lieutenant Colonel Chukwuemeka Odumegwu-Ojukwu, Military Governor of Eastern Nigeria, witi di pawa wey I get, I dey diklia say di land, sea and evritin wey dey Eastern Nigeria go now bi di kontri wey dem go kol "Ripoblik of Biafra."
- 30 May, 1967, as Bernard Odogwu (1985) to am No Place To Hide – Crises And Conflicts Inside Biafra.
- Naija Federation today koropt, e no dey grow, e dey opres popul, and e no fit chenj—just like Ottoman Empire wey dey Eastern Europe meni yias ago. Na di British join Naija togeda like dis, and dis kain arenjment no bi wetin Afrika pipul nid at ol. Yet dem dey fors os to sofa just to protect dat yuzles krieshon wey no get eni rizin for histri or wetin di pipul rili want.
- 1969, as Rudolph Okonkwo tok am, My Last Interview With Dim Chukwuemeka Ojukwu - Rudolf Okonkwo, Sahara Reporters (26 November, 2011)