Daniel Acharuparambil
Hau e go bi
Daniel Acharuparambil (wey dem bon for 12 May 1939, and e kpai for 26 October 2009) na Indian Katolik Choch big pastor wey be Archbishop for Archdiocese of Verapoly.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- For Asia wey get big-big way of deep prayer life, tok-tok bitwin difrent rilijon dey veri impotant. Wi go get beta mesej for Asia onli if awa Asian broda and sista si say God dey rili show for awa life. Dis kind tok-tok no dey against Choch wok, e dey inside Choch wok, wey mean say mek Choch dey show God presence to all pipul eni time wey God want am.
- Di faith don pas from one jenereshon go anoda genereshon tru sofrin and sakrifais, and Choch must protect dis faith by force of duty.