Don Jazzy
Hau e go bi

Michael Collins Ajereh (wey dem bon for 26 November 1982), wey pipul sabi as Don Jazzy, na Naija muzik produsa. Na im stat one muzik grup wey dem dey kol Mavin Records for 2012, and na im bi oga for dia. E don sign atist like D'Prince. Bifor dat one, e and D'banj stat Mo' Hits Records for 2004. E stil wok as muzik produsa for Kanye West record grup wey dem dey kol GOOD Music from 2011 reach 2015.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Mi I bi pesin wey dey bake bred. If yu kom mai shop, na bred yu wan bai, no bi mi wey bake am.
- Don Jazzy: The secret of my success. 30 November 2015, PMNews Newspaper.
- Mek yu trai bi yorsef, no kopi anoda pesin.
- Don Jazzy: The secret of my success. 30 November 2015, PMNews Newspaper.
- Wi for Mavin don chenj from dropin song on Friday to Wednesday or Thursday. Na bikos nau, evri Friday, anoda atist dey drop song join.
- Why I don’t allow my artistes to release songs same day as Wizkid, Asake’ – Don Jazzy. Daily Post. 25 July 2024
- Wi gatz fix hau tins dey wok for dis kontri. Wi gatz train awa boiz wel from smol.
- If a producer demands sex, call him out – Don Jazzy. 5 May 2021, Punch Newspaper.
- If mai atist wan drop song on Friday and I hie say Wizkid or Asake sef go drop song dat same day, I go shift awa own. Bikos I no wan mek awa song just kpai like dat for noting.
- Why I don’t allow my artistes to release songs same day as Wizkid, Asake’ – Don Jazzy. Daily Post. 25 July 2024