Jump to content

Durella

From Wikitok

Oluwadamilare Okulaja, wey pipul sabi as Durella (King of the Zanga), na Naija musikshan, paforma, songraita biznesman. Plenti pipul sabi am wit songs lik "Enu Ose", "Shayo", "Wizkolo Wiska", "Club Rock" an "GaGa" wey e do wit Wizkid.

  • Ol dis rekod label dey cheat, evun ol dis sho promota dem. So di best way be say mek you jos do your own tin by yoursef, push am go outsaid, you onderstand, an just remain yoursef.
  • One tin abaut dis musik game be say you fit no sabi wen e go pay. You go dey push one year, notin dey hapun; you go stil push next year, notin dey stil hapun. But you fit no sabi di tiam wey sumetin go wan hapun. So no eva giv up abi taya.