Ebenezer Obey
Hau e go bi

Ebenezer Remilekun Aremu Olasupo Obey-Fabiyi MFR (wey dem bon for 3 April 1942) wey pipo sabi wel wel as Ebenezer Obey na Naija juju muzishan.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I no fit imagin am sey I ritaya from muzik. If I stop to dey play muzik, e go jos bi like sey part of me kpai. Muzik na my pashon, my love, an di tin wey dey give me hapiness. Wen I dey sing, I dey get plenti joy wen I luk pipo faze sey dem dey hapi wel wel.
- Evangelist Ebenezer Obey: The Juju Legend Who Defied His Mother’s Wishes to Follow His Dreams 2024, THISDAY (Nigeria).
- In orda for you not to bi old-skul, you go nid to dey hajos an dey chenj your patas. If pipo no kom like you again, you no get eni oda option dan mek you ritaya.
- Evangelist Ebenezer Obey: The Juju Legend Who Defied His Mother’s Wishes to Follow His Dreams 2024, THISDAY (Nigeria).
- For me, I bi like wota, I no get enimi.
- How I derive inspiration for my songs —Ebenezer Obey 3 April 2020, Nigerian Tribune.
- Meni times, man go wan dey do like God, but dat one no fit hapun. No man go fit bi like God. No man fit de equal with God.
- How I derive inspiration for my songs —Ebenezer Obey 3 April 2020, Nigerian Tribune.