Jump to content

Eedris Abdulkareem

From Wikitok

Eedris Turayo Abdulkareem Ajenifuja (wey dem bon for 24 December 1974) wey pipo sabi wel wel as Eedris Abdulkareem na Naija hip hop singa an song raita. Na Abdulkareem bi di lid singa for di forma muzik band wey dia nem na The Remedies. Abdulkareem na one of di singa wey mek hip hop muzik popula for Naija. Pipo dey si am as one of di most popula hip hop muzishan in Naija.