Efa Iwara
Hau e go bi

Efa Iwara (wey dem dey bon for 20 August 1986) na Naija aktor and rapa wey pipul sabi wel wel as Efa.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Always dey see your cup as sey di wota wey de inside rimen half mek e full no bi sey e rimen half mek e finish, an neva give up.
- I’d love to be behind the camera – Efa Iwara 31 August 2025. DAILY TRUST (Nigeria)
- Tins no dey fest dey easi wen you wan start eni-tin for dis life, weyda na skul or supa-maket, bizness or you wan bi DJ or eni-tin .
- I’d love to be behind the camera – Efa Iwara 31 August 2025. DAILY TRUST (Nigeria)
- Mek pesin akt di life tori of a popular pesin na im bi di ril aktin bikos pipo go dey kompiya wetin you dey do to di vashon of di ril pesin. Wen you dey akt tori for fim, na you dey hajos di tori by yousef. Wen you dey akt true tori of someone like Ojukwu, pipo no im voice, di way e dey kari bodi. Na dat kind of aktin hard pass for eni aktor.
- Efa Iwara talks 'Princess on a Hill,' dream roles, and the realities of acting 14 February 2025, PULSE (Nigeria)
- Notin gud dey kom easi. Pesin go nid to work wel, dey strong, dey beg baba God an dey redi to do pass as e dey do bifor.
- I’ve learnt to remain humble no matter the hype –Efa Iwara 02 June 2019, PUNCH (Nigeria)