Emmanuel Emenike
Hau e go bi

Emmanuel Chinenye Emenike (wey dem bon for 10 May 1987) na Naija futbola wey don stop to dey play. Im posishon na strike.
Tins wey e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I dey veri hapi for hau I tek play, I hapi for mai tim-mets, and I hapi wel-wel say I kom from kontri wey dem dey kol Naija. Di gold medal wey I win for AFCON show say I trai wel. Di awod wey I get as top goal skora for AFCON tok plenti abaut hau I put bodi and trai for di tim. Super Eagles na kamp, no bi famili haus, and e no sopos bi ples wey dey fia pesin.
- Emmanuel Emenike quits Super Eagles. Premium Times Nigeria, 19 October 2015.
- I neva tok say I wan big pas Yekini. Abeg, I jos dey do mai own wok, dey trai mai best for Naija.
- Emmanuel Emenike: I Never Said I Want To Be Bigger Than Yekini. All Nigeria Soccer. 18 October 2013.
- I go tra sko gol as I fit, bot dat one no bi di most impotant. Wetin mata pas bi say mek Naija win and bi champion.
- Emenike wants to win tittle to boost career. Vanguard News, 18 January 2013.