Fabio Betancur Tirado
Hau e go bi
Fabio Betancur Tirado (wey dem bon for 30 October 1938, and e kpai for 20 November 2011) na Colombian holi man for Katolik Choch wey don serve as auxillary bishop for di Archdiocese of Medellín, bishop for di Diocese of La Dorada–Guaduas, and also as archbishop for di Archdiocese of Manizales.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Komunion show inside solidariti, na tru way to show di lov of God and lov for oda pipul, and e must show tru servis to evribodi, for evri sitweshon and for evriwia, like for govment mata, for work and biznes, and for kolsho. Wen evangelization dey aktiv inside dis spirit, e go produs holines, and na dis holi life wey di merciful lov of God don kol all of us to liv.