Femi Adebayo
Hau e go bi
Femi Adebayo Salami (wey dem bon for 31 December 1978) na Naija man wey dey act film, direct film, do law wok, produs film, plus e stil dey wok as speshal advaisa giv Kwara State Govnor for Art, Kolsho and Torizim mata. Im papa na Adebayo Salami, wey stil dey act film for Naija.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I don len say frend or enemi no dey last foreva. Evribodi sopoz be yor frend, bikos ol of os nid to hold hand togeda to fit do beta tin.
- Femi Adebayo: My father doubles as my boss in the industry. The Guardian (Nigeria), 4 June 2022
- Evri wuman get di levul of wahala wey shi fit bia. No bi evri wuman sabi tek plenti stres. Me I tank God say my wife sabi my wok, bot I stil dey try mek I no pas my bandari wen I dey relate wit wuman wey no be my wife.
- Day a fan kissed me in the presence of my wife — Femi Adebayo. Vanguard (Nigeria), 23 November 2014.