Femi Kuti
Hau e go bi

Olufela Olufemi Anikulapo Kuti (wey dem bon for 16 June 1962), wey pipul sabi as Femi Kuti, na Naija muzishan wey dem bon for London but e grow for Lagos. Na im bi di first pikin of Fela Kuti, wey stat Afrobeat muzik. Im grandma na Funmilayo Ransome-Kuti, wey dey fait for women rait and do politis, plos shi bi big wuman for tradishon tu.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- If wi no ondatand say ol of os na one pipul wey dey liv for di same world, wahala go plenti—wey bi wetin don olredi dey hapun.
- Femi Kuti Is Leading Afrobeat Into The Anti-Trump Era. 21 February 2018, Okay Africa.
- Notin dey big pas di lov wey yu get, and to si say yor pikin join yu for wetin yu like to du—and e dey du am wel wel.
- Femi Kuti Is Leading Afrobeat Into The Anti-Trump Era. 21 February 2018, Okay Africa.
- Afrika go always put beta hand for tins like sports, muzik and film, bikos wi bi pipul wey sabi stand strong no mata wetin hapun.
- Femi Kuti congratulates Burnaboy, Wizkid for grammy win, speaks on music in Africa. 24 March 2021, Africa News.