Jump to content

François Norbert Blanchet

From Wikitok
Francois Norbert Blanchet

François Norbert Blanchet (wey dem bon for 3 September 1795, and e kpai for 18 June 1883) na Canadian holi man for Katolik Choch wey serve as archbishop for di Archdiocese of Oregon City.

  • Wi gatz enta kontri wey no Katolik priest don eva go bifor. Di rivas, lakes, mountains, grasslands, forests and hills of Oregon go soon dey ful wit praise of di Holi Nem of Jesus; wi go plant di kros from one place rich anoda, from shore rich shore, for one big land wey stil dey wait mek wi waka am, and di word of Jesus wey tok say dat sign go draw evribodi kom mit am go show for dis pwo sheep wey dey waka waka wey dem send us go mit. Na big joy! Na swit komfot for mishonaris!