Francis Arinze
Hau e go bi
Francis Arinze (wey dem bon for 1 November 1932) na Naija bishop for Katolik Choch. Bifor-bifor, na im bi archbishop for Onitsha Katolik Diocese.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- E dey wori kontri wel wel if plenti of di yong pipul or pipul wey go skul like dokto and graduate wan komot go anoda kontri. If meni yong African pipul ron go Europe or America, who go mek shwo say dem get beta wok, mari beta pesin, and get gud life for fusho? No bi dis same yong pipul dem sopoz help build dia own kontri? Europe and America no sopoz help African lidas mek dem enkorej dia pipul mek dem stay for haus and build dia neshon?
- If yu no sabi anoda pesin rilijon, yu nevea ivun stat. And if yu no fit listin, na onli to tok yu sabi, yu stil dey yor own. Yu dey prich giv evribodi wey nia yu, bot yu no dey rili tok wit enibodi. Som tins dey wey human hat dey find. E fit be say di way dat pesin dey find am for inside dia rilijon get smol mistek. Bot evri human hat wey God mek, dey find God.