Garba Lawal
Hau e go bi
Garba Lawal (wey dem bon for 22 May 1974) na foma Naija futbola wey dey play for left said for field. For 2014, dem mek am oga for Kaduna United football klob, bot im komot for dat wok for 2015. Nau, e dey wok for Nigeria Football Federation for wie dem dey plan hau futbol go waka.
Tins wey e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- For futbol, wetin impotant pas na mek you win. Nobodi go rimember if you play fain or no play fain. Na di three points na im mata.
- Garba Lawal Warns Eagles Against Another Upset Versus S’Leone THISDAY (Nigeria), 15 June 2023.
- Laif dey chenj evriday. Wetin futbol moni bi bifor no bi wetin e bi nau.
- Fans’ criticisms didn’t bother me while I was in Eagles – Lawal Punch (Nigeria), 16 February 2020
- You no fit chenj human bin, na onli God fit du am.
- Atlanta 96 Olympic win was turnaround for northern women –Garba Lawal. Premium Time (Nigeria), 17 August 2019.