Goodluck Jonathan
Hau e go bi

Goodluck Ebele Azikiwe Jonathan (wey dem bon for 20 November 1957) na Naija politishan. E bi Presido of Naija from 2010 to 2015. For 2015 eleshon, e luz giv Muhammadu Buhari wey bi foma militri head of state. Jonathan na di first sitin presido for Naija wey gri say e luz eleshon without wahala.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Gud govment no bi somtin wey pesin fit jos komand like for kontri wey get one-man pawa and e no bi jos law wey dem fit rait for paper for democracy. Na wen evribodi kom gri say mek wi du wetin gud and du am for beta rizin, na im e go wok.
- INTERVIEW: The Legacies I Left For Nigeria — Ex-President. Premium Times Nigeria, 11 October 2019
- I biliv say wit di tins wey wi don du bifor wi komot, and di one wey di new govment go stil put, wi go fit fait dis terror wahala rich beta end.
- Video: Goodluck Jonathan talks of Boko Haram fight. France24.com, 28 January 2016
- I dey always ask pipul: Na say light dey 24 hours bifor, den Jonathan kom off am and spoil the machin? Di ansa na no. Light wahala don dey Naija sins, and wi sopoz ondastand say no bi today e stat.
- EXCLUSIVE INTERVIEW: You will soon see that APC is grossly overrated, says Jonathan. TheCable, 26 March 2015.
- I fit tok am klie say, no fight go hapun bikos of mi or bikos of wetin I want. I tok am klie klie.
- Transcript: CNN interviews Nigerian President Goodluck Jonathan. CNN.com, 1 October 2010.