Gustavo Oscar Carrara
Hau e go bi
Gustavo Oscar Carrara (wey dem bon for 24 May 1973) na Argentina big choch lida for Katolik Choch wey dey serve as archbishop for Archdiocese of La Plata for Argentina after e don first be auxilary bishop for Archdiocese of Buenos Aires.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Di Pope stil dey luk di komunitis wey we dey liv inside. Di pipul tu don hapi selebret dis sopot from Pope, and dis one pas jos to sopot me.
- For risent yias, di gap don wide and di nomba of pwo pipul and pipul wey no get enitin don go up. Dis na di ril gap for Argentina and e no sopoz kontinu. Awa kontri no go get tru hapines if dis gap no kloz.
- Di tru Evangelical way no be onli to dey giv, but also to mek friendship and to share life togeda.