Jay-Jay Okocha
Hau e go bi

Augustine Azuka Okocha (wey dem bon for 14 August 1973) wey pipo sabi wel wel as Jay Jay Okocha na Naija forma futbola wey dey play for atakin-midfid for di tim.
Tins wey e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I tink sey evri pleya dey difren. We get plenti pleya for Bundesliga wey sabi play wel wel. But no bi sey I wan kari bodi up, e bi like sey I de spesha smol pass dem
- Jay-Jay Okocha interview: Beating Oliver Kahn to score what Jurgen Klopp called the greatest-ever Bundesliga goal. Sky Sports, 9 September 2022.
- Di difren bi sey for oyinbo kontri (Europe), you get evri-tin wey you nid to fit bikom a beta pleya an you dey play onda beta Koch an beta envaromet. For Naija (Nigeria), we no get beta tins wey pleya nid an di wan dey mek am hard for smol smol pleya to fit bi beta pleya. I dey looki sey I japa komot from Naija kwik kwik.
- Jay Jay Okocha: Nigeria Can’t Bring Out The Best In Players, I’m Lucky I Left Early. Arise News, 14 May 2023.
- Maybe Chelsea futbol klub for don give my klub 1 billion Euro bikos of me. Chelsea give £106 million for dia difensiv mifida wey kom from Portugal. My klub for kolet around €150 million from dem. Di way I dey dribbu, di way I dey helep my tim pleya for dem to fit score. Na dat moni for de ok for pleya wey get kwuliti like me.
- Jay-Jay Okocha: The dazzling dribbler who danced his way into football greatness. FIFA, 27 April 2023.