Joeboy
Hau e go bi

Joseph Akinwale Akinfenwa-Donus (wey dem bon for 21 May 1997), wey pipul sabi as Joeboy, na Naija singa and songraita. E dey onda Warner Music Africa, wey join bodi wit im own musik label wey dem kol Young Legend. Bifor, na Mr Eazi sign am onda emPawa Afrika, na dia dem diskova am for 2017 fom di emPawa talent program wey dey hep upcoming artists gro.
Joeboy music dey most taims na Afro-pop and R&B stai.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- E rili swit wel wel. As i tink bak now, i dey rison say e plenti, bikos i get plenti memories and tins wey I don si and pas.
- Joeboy interview. Tirade World Magazine.
- As i luk bak nau, e dey swit me to ci how far i don go, no be onli for musik, but evun for who i be as pesin, my characta, how i dey bihav, and how i don build confidence. E jos sho say if pesin focus, stay tru to e journey, and redi to len and gro, big big tins fit hapun.
- Joeboy interviews. Tirade World Magazine.