Joel Amadi
Hau e go bi
Joel Amadi, wey pipul sabi as Joe El, (dem bon am for 23 March), na Naija afrobeat singa, songraita and parforma. E dey onda Kennis Music label.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- To be beta goalkeeper no be smol wok. No be onli di normal training wey your koch go giv you, you stil nid get som tins for bodi wey God don olredi put. You sopos sabi mek shap shap dicishon and your bodi sopos quick to respond enitiam bol dey kom.
- I stopped goal keeping for music – Joe El. 23 March 2024, Punch Newspaper.
- Na praya dey hep me stay strong. Enitiam I dey feel weak or my mind dey low, I go jos tok to God. I go beg am mek e giv me pawa, bikos I gats stay aliv and strong for my mama and my sistas.
- I’ve been fighting bandits in my dreams since my father died – Joe El. 20 June 2021, Punch Newspaper.
- Plenti big nems wey don dey di musik industri bifor no fit drag levu wit niu artistes nau. But to dey kol dem 'up-and-coming' no sho say we apreshiate ol di beta wok wey dem don do bifor.
- I’ve been fighting bandits in my dreams since my father died – Joe El. 20 June 2021, Punch Newspaper.