Joseph Danlami Bagobiri
Hau e go bi
Joseph Danlami Bagobiri (wey dem bon for 8 November 1957, and wey kpai for 27 February 2018) na Naija bishop for Katolik Choch. E wok as bishop for Kafanchan Diocese.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- For Naija, chans to sovaiv plenti pas wetin we dey tink say dey Europe or oda ples. For inside ol di plenti tins and nashoral blesin wey God giv Naija, awa pipul no sopoz dey pwo or dey rosh komot go anoda kontri go find beta life. Na awa pipul dey travul go obodo-oyinbo to go chop di beta tin wey dia govment don arenj, bot wi wey dey hia no wan fix awa own land.