Jump to content

Joseph Yobo

From Wikitok

Joseph Michael Yobo (wey dem bon for 6 September 1980) na foma Naija futbola wey dey play for senta bak. E bk kapten for Naija nashonal tim bifor e stop to play for kontri for June 2014.

Tins wey e tok

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • E swit me say dem wan mek evribodi join di futbol enjoiment bai showin am for pipul haus. Di way dem ridus moni for woch bol go help dia kostomas enjoi wel wel and bi pat of histri. I biliv say di Super Eagles pleyas wey dey nau go du wel for Russia.
  • Di joni long wel. E big no bi smol. I fil say na God plan am—bikos e no bi di nomal way. I no play for Naija league at ol, and na dat one dey mek pipul get chans to play for abroad. For 1998, I go Belgium, den for 2001 I go Olympic Marseille, and for 2002 I enta British league.