K1 De Ultimate
Hau e go bi

K1 De Ultimate (im ril nem na Wasiu Omogbolahan Olasunkanmi Adewale Ayinde Marshal, wey dem bon for 3 March 1957) na one Naija Fuji muzishan. Na im mek one kain stai of Fuji wey dem dey kol Talazo Fuji popula. Dis stai kom fom wetin Ayinde Barrister, di orijina Fuji kroieto, stat. E muzik dey swit ol kain pipul—yong, old, Yoruba, Igbo, Hausa, enibodi.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Wetin dey had pas na hau to bring pipul kom togeda mek dem agri.
- K1 De Ultimate Speaks on Alleged Maltreatment of Band Member. May 2024, Thisday Newspaper.
- Jos fes wetin rili mata—na yor wok, yor talent.
- K1 advises up-and-coming musicians to shun drugs. 18 March 2022, Punch Newspaper.
- If wi du wetin koret, ivun afta wi don waka go (kpai), di tori of wetin we du go stil rimen for grand.
- I never fought with Ayinde Barrister, K1 Ultimate insists. 16 March 2022, Punch Newspaper.