Koffi Idowu Nuel
Hau e go bi
Koffi Ayinde Idowu Nuel, wey pipul sabi as Koffi na Naija entertaina, komedian, musican, and akto. Dem bon am on 11 March 1977. Im mama na Togolese wuman and e papa na Naija man fom Ibeju-Lekki.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Mek you dey reel and no kopi anoda pesin.
- Before Stardom With… Koffi Idowu-Nuel. 24 May 2025, Punch Newspaper.
- Sins Instagram don dey for lik 10 years, Naija blog wod don spoil di way meni Naija sabi risin. Instead of beta knowledge, dem don dey mek pipul wey no sabi but get smol edukeshon. Dem dey olways sho kontent wey no get manners, no get valu, dey hail empty sho off and fulishnes.
- Stop promoting toxicity, Koffi slams blogs. 2 March 2025, Punch Newspaper.
- For media today, pipul no dey respet koret behaviour again. Na lie lie stori, ashawo mata detti kontent and scandal dem dey push as di main tin.
- Stop promoting toxicity, Koffi slams blogs. 2 March 2025, Punch Newspaper.
- Olmost everi month, one Naija komedian dey fil big hol for difren citi.
- My 25-year comedy career marked by grace, says Koffi tha Guru. 28 January 2024, Punch Newspaper.
- Pipul dey tink say bikos i be entertaina, i sopos tek som kain bad laifestai wey i no lik. But me, i dey do my own difren so dat anoda pipul fit get chans tu.
- I’ve lost opportunities for being truthful – Koffi Tha Guru. 12 February 2022, Punch Newspaper.
- Bifor, musicians wey dey sing for dia triab dey mek swit song wey stil dey tich lesson, wisdom and knowledge. But today music don lose meni of dat tin.
- I’ve lost opportunities for being truthful – Koffi Tha Guru. 12 February 2022, Punch Newspaper.
- Som tins sopos remain private. Sex, wey be crious and spirishual mata, na one of dem.
- I’ve lost opportunities for being truthful – Koffi Tha Guru. 12 February 2022, Punch Newspaper.