Korede Bello
Hau e go bi
Korede Bello (wey dem bon for 29 February 1996) na Naija singa and songraita pesin wey dey sing and rait music.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- You go forget wetin rili important if you dey olways run afta di nex big song, or enitin wey go mek pipul
dey tok about you. Na so meni artists dey get hooked for dat kain wahala, dem no fit komot for dat cycle.
- Korede Bello reflects on journey after leaving Mavin Records. 5 September 2024, The Nation Newspaper.
- As artist, you no go sabi evritin. Somtaims, na your song go waka pas you. The song fit rish pipul wey you no go eva meet for your laif. Na dat kain tin dey sho say the song big wel wel.
- I didn’t intend to make music for Nigerians, says Korede Bello. 2 April 2023, The Cable Newspaper.
- Musik no get boundri, e no mata wia you fom or wia you dey, musik fit stil rish evriwia.
- I didn’t intend to make music for Nigerians, says Korede Bello. 2 April 2023, The Cable Newspaper.