Jump to content

Loris Francesco Capovilla

From Wikitok
Loris Francesco Capovilla

Loris Francesco Capovilla (wey dem bon for 14 October 1915, and e kpai for 26 May 2016) na Italian big choch lida for Katolik Choch.

  • Di time wey dem chuz John XXIII as Pope, plenti pipul get difrent esplaneshon and plenti of di esplaneshon stil strong, but e no fri from komplen. Pipul wey biliv say Holy Spirit dey help no dey sopraiz for enitin, even di old age of di man wey dem kol, and plenti times dem dey hapi; but even pipul wey dey get dobul mind, bikos dem dey si di choch wit smol eye and no si di ful pawa of God, stil biliv say dat chois respet one holi Bible man.