Lucius Iwejuru Ugorji
Hau e go bi
Lucius Iwejuru Ugorji (wey dem bon for 13 January 1952) na Katolik bishop for Naija. E bi Archbishop of Owerri and olso Presido of Catholic Bishops' Conference of Nigeria.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Choch for Africa sopoz help pipul chenj hau dem dey trit envaroment. Wi go tich pipul mek dem sabi say if wi no tek kia of awa land and wota, e go spoil evritin. Awa pikin dem wey go kom tomoro get rait to liv for beta ples wey klin and gud for bodi.
- Pis na di solid grand wey development dey grow on top. Witout pis, beta life no go last. Pis go fit stay onli wen pipul no dey hongri, pwo, jobles or sofa opreshon. Wi must join hand to stop ol di wahala and kilin wey dey mek awa pipul fie. I dey beg ol di politikal faitas for dis State – mek una drop una wepons. Wahala dey bring more wahala.