Malcolm Guite
Hau e go bi

Malcolm Guite (wey dem bon 12 November 1957) na Inglish poet, singa, Anglican pasto, and ticha.
Westin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- One big beta tin abaut season – both di one wey nesho get and di one wey choch dey folo – na say dem dey ton slowly on dia own, no mind hau pesin dey fil. If I dey sad, Easter stil go remind mi say Jesus rise from det. If Krismas don mek mi dey tink of shopin tu moch, Advent go remind mi say wetin I rili nid na di Savior wey dey kom, and I sopoz redi for am. So dis kain season and old choch way to dey du tins dey help fri os from di wahala of mud wey dey chenj enihau. Dem bi ril blesin.
- INTERVIEW WITH MALCOLM GUITE – AFTER PRAYER (September 22, 2019)