Mike Abdul
Hau e go bi

Michael Olayinka Abdul (wey dem bon for 12 February 1977), wey pipul sabi wel-wel as Mike Abdul, na Naija gospel muzishan, muzik produsa and pesin wey dey rait song.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Worship no sopoz dey dol or folo one kain stai. E fit dey lively, fit kari awa lokal way, and stil dey strong for spirit for di sem taim.
- I am spiritual yet streetwise – Mike Abdul. 19 July 2025, Punch Newspaper.
- Ministri no dey onli hapun wen pesin dey prich. E fit stil sho for fim, pley or insaid di laif of pesin wey dey akt sometin.
- I am spiritual yet streetwise – Mike Abdul. 19 July 2025, Punch Newspaper.
- Disiplin na di main tin. Marej no be somtin wey yu go enta jos bikos odas dey mari. Na big disishon wey yu sopoz tink wel bifor yu du am.
- Abdul: Innovation is Expanding Frontiers of Gospel Music in Nigeria. June 2025, This Day Newspaper.