Muhammadu Buhari
Hau e go bi

Muhammadu Buhari GCFR (wey dem bon for 17 December 1942, and e kpai for 13 July 2025) na one Naija politishan wey rul as Presido of Naija from 2015 rich 2023. Bifor dat one, e don be big oga for Naija ami. E rul Naija as militri oga from 31 December 1983 rich 27 August 1985, afta e and ami pipul kari pawa by force. Pipul dey kol e style of rul "Buharism" bikos e like strong hand for kontrol.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]1980s
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Di last jeneral elekshon no fri, no fair at ol. Di onli politiks parti wey fit shout say dem du magomago, na di parti wey no get moni to du magomago. Wi si klia say magomago and bad bois wey fayit for vote dey folo hau moch moni each parti get. Dis one show say di politiks parti neva get trust for di presido style of govment wey Naija don spend plenti moni and pipul pawa put.
- Buhari fest tok as Militri Oga for Naija (December 1983)
2010s
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I no bi for onli one pesin, I dey for evribodi, and I no dey for enibodi.
- Buhari presido fest tok (May 29, 2015)
- I no sabi which politiks parti my wife dey, but I sabi say shi dey my kichin, my palo, and dat oda rum.
- My wife belongs to my kitchen, the other room –Buhari (October 14, 2016)
- Dis niu govment go hold tayit di gud tins wey we don du for di last four yias, fix di mistek wey human hand no fit doj, and fayit di niu wahala wey dey face di kontri. Wi go plan bold plan wey go chenj Naija for beta.
- Democracy Day tok 2019 (June 12, 2019)
- I enta dis world wit emti hand and I go waka komot wit emti hand. Why I go tif?
2020s
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Naija dey wori wel wel about bad maket for smol guns and light wepon wey dey waka enihau for di world. Dis tu moch gun mata dey spoil plenti life and dey kos wahala for moni and pipul livin, espeshali for Africa.
- My pipul, bikos una sopot mi and my politiks parti wel wel, I stat dis joni wit plenti hope from una. I no kom hia just to tok wetin swit for ear, I kom do di ril koret tin wey go beta life for komon Naija pesin.
- Buhari last tok as presido (May 29, 2023)