Norbert Young
Hau e go bi
Norbert Young na Naija aktor wey don akt inside meni TV fims like Third Eye, Tinsel, an Family Circle. Young don evun de inside plenti Naija fims an play.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Na grace of God fit mek pesin dey kari bodi down.
- INTERVIEW: Women earn more in Nollywood because of their bargaining power, says Norbert Young 17 March 2024, THE CABLE (Nigeria)
- If pesin no get hope den pesin no get risin to dey alive bi dat. I get hope an I no go eva give up on Naija mata.
- INTERVIEW: Women earn more in Nollywood because of their bargaining power, says Norbert Young 17 March 2024, THE CABLE (Nigeria)
- Pipo luv wumen, dey luv wetin wumen dey do an dis one dey mek dem dey get moni. Dis one no mek bi bad pipo; wumen dey risiv gift pass man.
- Why women earn more in Nollywood – Norbert Young 19 March 2024, THE NATION (Nigeria).
- If pesin do im job well an e put bodi into am, pesin no go eva bi old skul. Na bikos I de sirious an dey put bodi for my work with oda karata wey I get kari me rish wey I de now.
- Love, friendship bind us together—Norbert and Gloria Young 23 January 2022, THE PUNCH (Nigeria).
- Jos as life sef bi, we must dey do awa best to beta for evri-tin wey we dey do.
- Love, friendship bind us together—Norbert and Gloria Young 23 January 2022, THE PUNCH (Nigeria).
- Pesin dey fall in luv an dey mari. If pesin find almost evri-tin wey im like in a wuman, na to mari rimain. E no konsain di man wia di wuman kom from or wetin di wuman dey do to chop.
- Love, friendship bind us together—Norbert and Gloria Young 23 January 2022, THE PUNCH (Nigeria)
- Evri-bodi get talet to fit bi eni-tin; Na wetin pesin give im time to go leta bi di pesin work.
- I don’t know what happened to my Tinsel role –Norbert Young 27 April 2017, THE CABLE (Nigeria)