Jump to content

Nwankwo Kanu

From Wikitok
Nwankwo Kanu (2017)

Nwankwo Kanu (wey dem bon for 1 August 1976) na Naija futbola wey don ritaya. E dey play for front to sko gol. E play for Naija tim Iwuanyanwu Nationale, for Ajax (Holland), Inter Milan (Italy), and for England, e play for Arsenal, West Bromwich Albion, and Portsmouth. E stil play for Naija nashonal tim.

Tins wey e tok

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Mai Naija pipul, I go tok am again, I no bi politishan, I bi futbola. Enibodi wey dey tok say I tel una to go vote for dis pesin abi dat pesin, na lai. Dem jos dey spred fake news. Mai nem na Kanu ‘Papilo’ Nwankwo, and evribodi sabi say na fubol I kari for hed ol mai laif.
  • I laik to stay on mai own. If yu si mi kom autsaid, e min say di tin rili impotant. Na wai yu no dey si mi evriwie, espeshali for pati or big event. No bi evri ples Papilo dey waka go, na mai chois laik dat.