Jump to content

Obafemi Awolowo

From Wikitok

Chif Obafemi Jeremiah Oyeniyi Awolowo (wey dem bon for 6 March 1909 and e kpai for 9 May 1987) na Naija lida wey fait wel-wel for Naija to get fridom. E help for di Fest and Sekond Ripoblik, and ivun durin di Civil War. E papa na Yoruba fama, and Awolowo wok had bai imsef to bikom gret man—nobodi dash am soses.

  • Naija no bi one ril kontri. E jos bi laik nem wey dem giv one eria for map. Pipul no rili dey fil say dem bi one, laik hau pipul for England go say dem bi English, or pipul for France go say dem be French. Di nem “Nigerian” na jos way to tok say pesin dey liv for insaid Naija land.
  • If di East said of Naija komot from Naija—weda na bai mistek or dem no komot—den di West said and Lagos tu sopoz komot from di Naija grup. Dem no go fit rimen insaid if di odas waka go.
    • Chief Awolowo's Speech to Western leaders of thought In Ibadan, May 1 1967, as quoted by Obafemi Jeremiah Oyeniyi Awolowo, (1967).