Jump to content

Olu Maintain

From Wikitok

Olumide Edwards Adegbulu (wey dem bon for September 1976), wey e stej nem na Olu Maintain (pipul stil dey kol am Mr. Yahooze), na musichan fom Nigeria. Na im and im cousin, Tolu Ogunniyi, stat one musik grup wey dem kol Maintain. One da pesin, Adeboye Bammeke, wey pipul sabi as Big Bamo, leta join di grup. Dis grup drop six musik album fom 1998 rich 2004. Dia popula song lik “I Catch Cold”, “Domitila” and “Alo” bifor dem separate for 2004.

  • Sex na pat of how human being be. Weda na for enjoimet or eni oda tin, sex dey natural. Sex dey impotant lik how pesin dey breathe. You no fit komot am fom how human beings tek be.
    • Di musik industri dey gro, e dey chenj smol smol. E dey turn to simetin wey dey mor swit. Plenti pipul wey get interest for di industri don dey put moni insaid am. But wrk stil remain. Evun though we don do meni tins, plenti stil dey wey we neva do.
    • Sex is like breathing – Olu Maintain. 21 February 2015, Vanguard Newspaper.
  • I no fit old maisef responsibu for how pipul go tek ci one wok of art. E be like painting — one pesin fit say dat painting worth millions of dollars, but anoda pesin fit say e no mek sens. Art na sumetin wey everibodi fit get dia own way to tek onderstand. Di way I tek xplain my own art dey veri clear.