Olusegun Obasanjo
Hau e go bi
Chif Olusegun Matthew Okikiola Aremu Obasanjo, GCFR (wey dem bon for 5 March 1937) na Naija politiks and ami oga wey rul Naija as hed of state from 1976 reach 1979. Leta, e kom bi Presido from 1999 rich 2007. Obasanjo dey biliv for Naija mata wel wel. From 1999 rich 2015, e dey for Peoples Democratic Party (PDP). E join dem bak again for 2018.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- For Africa to muv front, Naija gatz bi one of di main strong kontri. If Naija no strong, Africa no go strong. But di way Naija don dey for som yias now, e show say wi neva strong for haus, and na why wi no dey get vois for outside world.
- Full text: Obasanjo’s letter to Buhari. Punch, 24 January 2018
- Di lice wey dey chop govment skin na:povati, no sekuriti, bad moni manejment, put padi for posishon wey no bi im own, big neglect of wok, klos eye for bad tin, no progres, no hope for tomoro, Naija no dey united, and di gap bitwin rich and pwo dey wide. As long as dis lice dey awa bodi and povati dey shout for awa front, awa hand no go klin from wahala.
- Full text: Obasanjo’s letter to Buhari. Punch, 24 January 2018
- We get onli one road wey fit kari os komot from Egypt go promised land. Na to gada ol di pipul wey kia and redi for beta chenj. Chenj wey go giv hope and fusho to awa pikin dem, respet and space for ol awa wumen to join bodi.
- Full text: Obasanjo’s letter to Buhari. Punch, 24 January 2018