Pete Edochie
Hau e go bi

Chief Pete Edochie MON (born 7 March 1947) na Naija aktor. E popula wel wel for 1980s wen e akt di rol of Okonkwo for Nigerian Television Authority (NTA) version of Chinua Achebe buk wey dem kol Things Fall Apart.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- If you do Igbo man strong tin once for politis, na finish be dat. E no go gree mek you do am again. E go jos bone, pack komot for corner, sta dey worch. Na so norma Igbo man dey do.
- Why Igbo men struggle in politics – Pete Edochie. 24 July 2025, Premium Newspaper.
- Pesin dey tek oath wen e wan mari say e go stay for beta and for wors. No be onli wen tins dey swit. But meni pipul dey olways tink say anoda pesin own beta pas. Na dat mistake ol of us dey mek.
- Don’t leave your marriage over tough times – Pete Edochie. 5 August 2023, Punch Newspaper.
- If pipul bliv say di way I don sopot Nollywood don touch dia laif smol or big, e mean say beta tin go folo me. Na so success go giv me beta skore.
- Pete Edochie opens up on Yul’s second wife. 3 December 2022, Vanguard Newspaper.