Robert James Carlson
[[File:Archbishop-robert-carlson.jpg|thumb|Robert James Carlson (2010)]] Robert James Carlson (wey dem bon for 30 June 1944) na Roman Katolik big choch lida wey kom from America.
==Wetin e tok==
- Di choch, tru bishops, must tich di Gospel. I get duti to tich about human life and respect, marej and famili, war and pis, di nids of pwo pipul and di kol for jostis. As wi len durin civil rights fight, wi get moral duti to tok di trut about di respect of evri human being no mata di kolor of skin. E no mata if one politishan or pesin wey wan enta ofis gri wit us or not. Di same trut stil dey today.
- The Responsibility to Have a Well Informed Faith Life (August 2004)
*From di first senturi, Choch don tok about di bad of aboshon and di kilin of baby wey no fit defend himself for inside bele. Pipul wey tek aboshon play and si am like politis mata instead of serious moral mata dey break the Fifth Commandment. You no fit be “pro-choice” (wey min to sopot aboshon) and stil remain Katolik for gud way. Na why Choch dey ask pipul wey hold dis bilif mek dem no kolet Holy Communion. Wi no dey wicked or judge enibodi, wi just dey asept di trut say dis kain posishon na serious sin and e no fit mach Christian way of life. **Good Catholics Cannot Be Pro-Choice (July 6, 2010)