Jump to content

Runtown

From Wikitok
Runtown (2018)

Douglas Jack Agu (wey dem bon for 19 August 1989), wey pipul sabi as Runtown, na Naija singa, songraita, and produsa. E muzik dey mix Afrobeats, hip-hop, R&B, and reggae.

  • Old-time muzishan no dey yuz di same kind sound or di same kind name evri taim. Dem giv os plenti beta song, espeshali for 80s. Na dem inspaya os, like Fela. No bi onli e muzik, but e way of life tu. Fela dey fait for human rait, so even if yu no bi muzishan, yu fit stil len meni tin from am.
  • Gud muzik na beta sound. Enitaim gud muzik stat, yu no go tok say "abeg off am." Noise no bi gud muzik, noise na di oposit of gud muzik.