Samson Siasia
Hau e go bi
Samson Siasia (wey dem bon for 14 August 1967) na foma profeshona futbol strika for Naija. E don also be head koch for Naoja nashonal tim from 2010 go rich October 2011. Dem stil kari am kom bak as koch for 2016.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I bi lejend. I don pley bol, ivun brek my leg for dis kontri, and I don koch too.
- I broke my leg for Nigeria, Nigerian govt abandoned me – Samson Siasia Daily Post (Nigeria), 27 June 2021.
- As long as you sabi score goal, e no mata wie you go, you go stil score.
- INTERVIEW: What Nigeria must do to stop decline in youth football performance – Siasia Premium Times, 16 August 2020.
- For Naija, we like to win, but we no too like to prepare wel.Bot na onli wen we prepare wel, we go fit get beta chans to win somtin.
- INTERVIEW: I don’t think this set of Eagles can win the World Cup, says Siasia. TheCable (Nigeria), 30 April 2018.
- Futbol na game wey get three resolts—win, draw or lose. Evribodi dey pray to win, bot you no fit win evri time. Some games, you go play wel, bot you go stil draw or ivun lose; na dose kind mach dey pain pesin wel wel, and you no go eva foget am.
- Siasia My second chance to coach the Super Eagles will come – Samson Siasia THE INTERVIEW, 26 November 2015