Jump to content

Samuel J. Aquila

From Wikitok
Samuel J. Aquila

Samuel Joseph Aquila (wey dem bon for 24 September 1950) na holi man from America wey dey for Catholic Church, and e dey serve as the fifth archbishop for Denver area.

  • Wen pesin liv God, na onli himself go remain, and wen God no dey for di mata, e go hard to get rizin to du gud for odas. Hau I go rili kia for pipul if I no biliv say God dey? Di way wey dis world of today dey, wey dey kol itself sekula and libral, na to put eye for plesho and wetin dey benefit mi alone. Dat na why wi dey si yong pipul dey jump in and out of rileshonship without sirios tot or minin, and later dem no fit ondastand why dem no dey hapi.
  • I like to chalenj Christian pipul to grow for holines and to bikom saint. Wen I dey giv konfameshon prichin to children, I dey ask dem, “God kol una to bi saint?” E dey surprise mi say meni of dem go ansa no. Di adults wey dey dia dey luk shock wen I ask di kweshon. Na den I go tel dem say God kol all of us to holines, and God kol all of us to bi saint. Vatican II tich am; and Christ tel us for di Gospel.